Tuesday 5 November 2019

Lagos Conductor Wan Thief My Phone O!


Lagos Conductor Wan Thief My Phone O
Lagos Bus-Conductors

My waka with Lagos Bus-Conductor! 

As I dey go back my house yesterday, I been dey inside one molue wey dey go Ipaja from Oshodi so as we don dey reach Ipaja, the conductor come start to dey collect money come dey shout on top him voice for everybody wey dey the bus.


I jejely pack wella for the corner wey I been sitdown since I know say my trouser dey tight and I no fit comot my money from the trouser pocket give the conductor, so I come tell am make he wait small say I go give am the money later. The thing be say I sitdown beside this bus-conductor and the way the guy been dey eye me since wey I enter the bus no good at all, but I been free am unto say e fit be the hunger wey dey worry me since morning dey make me dey think things.

As I stop to dey press my phone come put am inside my pocket, the conductor just turn sitdown immediately, me I come reason say maybe him don taya na why him sitdown, but as I dey reason am I come say make I just free am because me too don too taya wella to dey think all these things.

E no reach five minutes, I come dey feel say my phone don dey move small small so I come touch my pocked make I dey sure, but the phone still dey there.
As we waka dey go I come dey feel like person hand dey enter my pocket so i cme do sharp sharp hold my pocket, come trace the hand make I know who get am. 

Na the conductor get am o, laugh no gree me hold again and the man wey dey my back been dey look us, he been wan know wetin I go do.  Omo e no even tey sef the bus come reach where I dey go, so I just come down waka dey go, I no even pay the guy and the funny thing be say the mumu conductor no even know wetim him go do sef, he just dey look me as I dey waka dey go my house with the bus money wey I no pay am.

Anytime wey remember the thing I go just dey ask myself, wetin this country dey turn into sef?!



No comments:

Post a Comment